A$AP Rocky dives into Rihanna’s arms as not guilty verdict is read at felony assault trial

 

Wetin we call dis Video,Watch: A$AP Rocky found not guilty in assault trial19 February 2025, 08:01 WATNew Informate one hour wey don pass

Court don find Rapper A$AP Rocky not guilty of firing one gun at im former friend.

One jury for Los Angeles free di musician, wey im legal name na Rakim Mayers, on two felony assault charges wey carry up to 24 years in prison.

Terell Ephron claim say di Grammy-nominated hip-hop star open fire give am during one argument for one Hollywood street on 6 November 2021, e say one of di shots injure im knuckles.

Mr Mayers, wey also be fashion mogul and di longtime partner of pop star Rihanna, deny di charges, e bin argue say di weapon na prop gun and say im former friend, wey call imself A$AP Relli, only dey after money.

As dem read di first not-guilty verdict on Tuesday, pipo shout and clap for court. Mr Mayers rush towards im family and partner Rihanna, wey bin siddon behind am. E dive over one wooden barrier to hug dem.

E hug im lawyers and e bin be like say tears dey im eyes as dem read di second not-guilty verdict.

A$AP Rocky siddon for onr table with lawyers for one LA courtroom as im trial continue.

Wia dis foto come from,Getty Images

“Thank God for saving my life,” Mr Mayers tok loud. E thank members of di 12-person jury.

Dem arrest di rapper on di two felony assault charges after one strong argument with im former friend for di heart of Hollywood.

Mr Mayers and Mr Ephron bin don know each other since high school for New York and bin dey part of di A$AP Mob hip-hop collective.

Dia friendship cool off as A$AP Rocky career take off.

Authorities say Mr Ephron meet Mr Mayers on 6 November 2021, one day after dem two get palava, outside one hotel, wey no far from di ogbone Hollywood Walk of Fame.

Fight burst as yawa gas.

Mr Mayers bin also dey alleged say e bring out gun from im waistband and point am give Mr Ephron, as e tell am say: “I go kill you right now.”

“E look me for my eyes and point di gun give me,” Mr Ephron testify.

Mr Ephron say e tell di rapper to fire di weapon, but Mr Mayers start to dey waka go.

As e comot, Mr Ephron follow, as e dey shout give am.

Prosecutors allege say na at dat point, Mr Mayers again pull out di gun and fire multiple shots, with one bullet wey dem sat touch Mr Ephron knuckles.

Most of di trial based on weda di firearm in question na harmless prop gun, as Mr Mayers defence tok, or weda na real weapon wey dey capable of causing harm, as Mr Ephron and prosecutors allege.

Di weapon never dey recovered by authorities.

Jurors bin watch some footage of di fight because some parts bin dey captured on surveillance video, including audio of gunfire, but no video evidence directly show any shooting.

Mr Ephron take two days before reporting di incident to authorities and e bring shell casings e say e pick from di scene.

But police wey respond to reports of one shooting for di area no locate any shell casings. Mr Ephron, wey say e go back with im girlfriend hours later, say e bin know wia exactly to look, but no surveillance footage support im account.

E bin no dey admitted to any hospital in Los Angeles and instead e go for medical treatment after e fly back to New York.

Attorneys for Mr Mayers suggest say Mr Ephron bin plant di shell casings to frame di rapper.

A$AP Rocky and Rihanna dey waka outside for Los Angeles

Wia dis foto come from,Getty Images

Wetin we call dis foto,Rihanna make appearance for di trial and siddon with di rapper family

Di trial get emotional moments and times wey e be like fight go burst, particularly wen Mr Ephron – di trial star witness – take di stand.